Gist & Gossip

NIGERIAN POLICE AND ARMED ROBBERS - 'WETIN DEY HAPPEN?'

My brother & and sister, this is another Gist about our one and only, the famous men in black. We know you go say gisters don come again. Remember the last time we gist about half-baked police graduate, but this time around na uncooked police officers.

The gist be say the Rapid Response Squad (RRS); Operation Fire for Fire (joint operation between police & army) were called to an armed robbery scene around Ketu for Lagos State, na the army team first arrive the scene and straight away surrounded the whole place dey wait for the police to join in as na dem dey get arrest warrant.


30 minutes later our MIB no show face, so dem come radio them again to remind them say innocent people still dey hostage by the hoodlums, una no go believe am say dem "Oga, anything for the boys" aka "Police is your friend" no show face until 3 hours later after the Police Commissioner throwey order say either make dem show up or face dismissal, when he was informed about this mayhem.

At last when they turned up at the scene, sweating, shaking and trembling for the fear of the Rambo's. Then the police men now suggested that instead make them burst into the house, them for use tear gas first, but dem no fit as nemesis go catch on them too.


The Army people come ask them say if they get loudspeaker make them announce say dey don surround the house make the robbers surrender but our MIB say loudspeaker dey for station (maybe dem forget am for ogogoro joint sef) make dem go bring am na so all of them load themselves for pick-up again, say dey wan go bring speaker, imagine o na to take style-style run away from the scene.


To cut the tory short na God say make them merge soldier and police together if not our police go dey take glory say na dem catch this and that like the way dem behave for Allen roundabout recently abeg make our IG do something.


 

NIGERIAN POLICE AND ARMED ROBBERS - 'WETIN DEY HAPPEN'
ROYAL RUMBLE IN SUPER FALCON'S CAMP
XMAS AWOOF LAND OC FOR YAWA
PASSENGERS DEMANDED $1.3M FROM 'NAIJA AIRWASTES'
FIRST BANK NIGERIA PLC- ...TRULY THE FIRST???
ABIA STATE GOVERNOR FINISH FIRST DEGREE
NIGERIA AIRWAYS OR "AIRWASTE"?
AWOOF DEY RUN BELLE
THE NEW IMPROVED KANU "JOGO BONITO"
CUNNY MAN DIE CUNNY MAN BURRY AM
Gisters chill out with KSA
"Intellectual intellects" = Gari for common man?
"Commonwetin"?
"Nigeria Airwaste"
 
Archives...

Copyright © 2000-2001, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.