|
Na
true be say shame no dey catch some people o, becos if some people
get shame how can we describe the actions of first lady of Nigeria,
Mrs. Stella Obasanja a.k.a 'Mama Pancake' and the governor
of Rivers State, Gov. Odili and his wife with some other government
functionaries coming to London during the last Miss World Pageant
that was shamefully taken away from our dear country Nigeria due
to the fact that a certain section of the country refuse to see
the light.
|
|
| What
are their reasons for coming to London? Wait! To give the Miss World
event a Nigerian flavour. See yeye people,
the thing wey we suppose host and dem carry am comot come bring
am to London and una still follow dem come as if say una no get
work to do back home. |
Why
the British government no take over the hosting of the event? Becos
dem get better thing to do and they are obligated to serve their
own people. There was a statement credited to the Miss World organisation
when dem no get the desired response here in London
"The Miss World event will hold in London
but with Nigerian flavour".
Abeg make una tell me how can 'akpu'
wey dem prepare for Peckham go better pass the one wey dem prepare
for Owerri, or the 'amala' wey dem prepare for Hackney go better
pass the one wey dem prepare for Oyo and the 'tuwo shinkafa' wey
dem prepare for Dalston go better pass the one wey dem prepare for
Zamfara? Abeg no way!
Dem say because of the riot in Nigeria e no dey safe to hold the
event there again. No be in the middle of drug war Colombia host
the Miss World event some years back? Same thing for Turkey and
Bosnia, wetin come happen for our own case? |
| But
for our government officials and our dear 'Mama
Pancake' na another
opportunity to get estacode so why not come to London and give the
event the so-called 'Nigerian Flavour' when we never tackle
the problem wey we get for home. No be only we Nigerians be 419
as these oyinbo people don label us. These oyinbo people too
na ogbologbo 419 if you fall into their trap. Dem know say Naija
get 'oil money' to spend so
why not say something wey go make their head swell and let them
pump their money into the event and wetin happen? Wetin dem need
our money for after dem don carry the event comot our country? Our
dumb government fell victim to the oldest trick in the book. |
Abi,
make una ask our government, wetin be the thing wey Nigeria and
Nigerians gain from 'hosting' the Miss World event in London,
nothing.
Except debt because one woman wey invest her life saving into hosting
the event dey cry all over London now say dem dupe her. Instead
dem carry our 'oil money' come here come dey rent expensive
hotels, wear expensive lace materials and jewelries, drink champagne
and dey organise talk of the town parties all over the place.
And to those women government
officials wey attended the event too, una no get husband for house
wey una go cook food for? No wonder oga dey impregnate house girl
for Naija when una no stay home to warm oga's bed as una don become
'Ajala travel all over the world'.
Well God dey sha!
 |
|
|