Gist & Gossip

OYINBO WAN PLAY FOR NIGERIA.

All of una wey dey say our sportsmen and women dey abscond to play for oyinbo country, una don hear the latest one for town about one oyinbo man wey wan play for Nigeria. Our reliable source tell us say the man na from Bosnia.

We no blame the Bosnian man, wey marry one of our naija sisters because he know say the cheapest way to get international media attention na to play for Nigeria, and he know say him country no fit play in the world cup.

My brother I get one message for you though, we get one thousand and one correct footballers for Nigeria to the extent say we fit raise four correct teams for any tournament, if our NFA officials no be Egunje officials. So we no need any help from Bosnia to defend our national pride.

If this oyinbo dey desperate for media recognition, make him try other African countries like Sierra Leone, Liberia, Senegal to mention just a few.

 

ANYIM TO LEAD SENATE TO NATIONS CUP.
OYINBO WAN PLAY FOR NIGERIA.
MONKEY DEY WORK BABOON DEY CHOP.
CONTROVERSY TRAILS AGBANI DAREGO
MISS WORLD EMBARRASSED…. HOW KSA RESCUED HER
WHY STELLA DANCED AT MISS WORLD DINNER
PAY AS YOU ‘GROAN’ [GO]
ANTHRAX SCARE IN NAIJA SCHOOLS
   
  Archives...
 

Copyright © 2000-2001, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.