|
[1]
Damages worth $1.3million as provided for under the international
air carriage convention on carrier liability (dem no know say
that one no fit work with Naija Airways?)
[2] Nigerian Airways to tender 'open
unreserved apology' to the passengers (if dem get 'close
reserve apology' make dem dey happy). Abeg e be
like say this people no know say apology no dey for our dictionary
in Nigeria, abi dem no know say 'awoof dey run belle?'
[3] Nigeria Airways to take responsibility for the reimbursement
of costs related to each passenger's accommodation, upkeep and
necessary expenses resulting from delays experienced in the said
flight even as it asked the airline to bear the legal fees of
attorneys retained by the passengers for purpose of claims arising
from the flight in question (even if government provide fund for
these purpose na one oga patapata
go embezzle am) How Nigeria Airways go pay bear the legal fees
of the attorneys? Na dem say make dem go get lawyer? Abeg make
we lef matter joo. Also dem wan make the airline pay for the accomadation
of the passengers. How? Dem no get house for Naija before dem
come?
Finally, she na the airline wey no fit pay their staff salaries
talkless of paying their pensioners go pay $1.3million for damages?
If dem pay 1.3 million kobo make the passengers dey happy. Shikena!!!

|