Gist & Gossip

PATRIOTIC EAGLES

We know say una go dey wonder say which one be this again for Gisters and we know say by now una go don dey crucify those boys for losing to Senegal.


But one thing be say, they are still patriotic to Nigeria more than you and I wey go just sit down there, cross lege, dey analyse match when we know even fit carry leg go up and down.

 

In Nigeria, all of us be the Technical Adviser, Coach, NFA Chairman and at the same time be the Patriotic Fan, but we no wan be the Players and those that decided to be, we go dey say they are too old, why younger players no come out, abi dem no dey born pikin again for Nigeria?
OK we get U-17 abi? Make we no just go there at all at all!! Because the one wey we dey call U-17 sef, old pass these our present Papa Eagles, Which means dem be Grand Pa Eagles.
So for these boys to come out of over 120 million to represent us, they do well O, abi no be same leg we get? And moreover we must understand that greater percentage of these boys have been in top flight football for about 10 years now, win laurels for both club and country, so they too get right to be TIRED.

I beg our Super Eagles make u no mind them, we no fit win every time, and again na farewell party we dey do for most of una this year, una don try, if NFA like make dem no find replacement for una na dem sabi.

Okocha, Kanu, Finidi, Oliseh, Bro Ike, Pastor Taribo and the the rest of you wey Nigerians dey call "Old Brigade", we want make una pack enough stuffs for party when una dey go Japan for the World Cup, since it is probably going to be the last appearance on the International scene for most of una,  na to party and unlimited enjoyment for u, even if una no fit go pass 1st round.

We at Gisters go understand, we are with una all the way.


UP SUPER EAGLES, UP GISTERS, UP NIGERIA!!!
 

 

PATRIOTIC EAGLES
SUPER EAGLES.....GOING! GOING!!.......?
CAMEROON'S "JUJU" AIDED VICTORY
Quotes From Nigeria-Ghana Match
SOUTH AFRICA, CHOP AND QUENCH
THE NEW IMPROVED SUNDAY OLISEH
Quotes from Mali
SUPER EAGLES IN FASHION SHOW.
KUFFOUR SENT HOME
ZAMBIAN PLAYERS AND COACH DOWN WITH FLU.
Mali Gist in Brief
ANYIM TO LEAD SENATE TO NATIONS CUP.
OYINBO WAN PLAY FOR NIGERIA.
MONKEY DEY WORK BABOON DEY CHOP.
CONTROVERSY TRAILS AGBANI DAREGO
MISS WORLD EMBARRASSED…. HOW KSA RESCUED HER
WHY STELLA DANCED AT MISS WORLD DINNER
PAY AS YOU ‘GROAN’ [GO]
ANTHRAX SCARE IN NAIJA SCHOOLS
Archives...

Copyright © 2000-2001, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.