But trust naija people they don change
the MTN slogan to ‘pay as you groan’
because of the alarming rate with which the rechargeable
card dey finish.
The
least card, na 1500 naira for a period of 15 days, but trust my
people whenever they reload the card, dem go call all the ‘you
knows’ even sometime to announce that they don get GSM
and before you know it, the card go don finish.
Who
go blame the MTN people abi na dem say make people dey
call their friends to know which kind pure water dem drink today
after lunch.
Nowadays when u see people dey use GEEZIM for road especially
those babes, na empty card dem dey carry O, dem go dey wait for
their sugar daddy to call them.
Also Oga MTN and Econet, abeg the price N50/min
wey u dey charge is killing, make una look into the matter
|