|
When
the legendary Pele talk am some years back say the first African
country wey go win the World Cup na Nigeria many people think
say the man dey craze. But as it was in the days of Jesus Christ,
the prediction don come true now. Una go dey wonder say we don
come again abi? But as Pele talk am, Nigeria don finally win the
first World Cup for Africa at last even without all the so called
"stars".
|
|
|
As
una know say we get plenty talent for Nigeria, as the Eagles dey
fumble and wobble in Japan during the last World Cup another set
of Eagles dey do Nigeria "proud" for another Asian country.
In
fact this set of Eagles wey Gisters don dey tip to take over from
the present "young old stars" beat every team including France
wey be the defending champion then.
|
All
the gist wey una dey enjoy since happened for one of Thailand's
most notorious prisons in Bangkok wey organise dem own version of
the World Cup during the last FIFA World Cup. As una know say na
everywhere Naija people dey, the team wey Gisters don tag them "Super
Prison Eagles" consist of convicted criminals mainly on drug issues
with some on death row but this no stop these talented boys in every
angle from getting Nigeria name on the limelight again.
|
 |
Na
these come bring us to the case of our "yeye" Super Eagles, upon
all the freedom and dollars wey dem get, dem no even fit go pass
ordinary first round of the World Cup, instead to play better
football na to argue about money dem know. As these boys don do
us proud now, we go beg the Nigerian government make dem go Thailand
go beg for the release of these boys so we go put them for Kirikiri
prison.
|
|
We go come get a coach for them (no be oyinbo coach o), so anytime
we get match we go just carry them with "Black Maria" and military
escort go stadium go play so that dem no go do another "Escape
to Victory". Shikena!!!
|
|