Gist
& Gossip
|
Bin
Laden stars in Rumsfeld Pillow Talk
|
|

|
I
think by now everybody go sabi the eccentric American Defence
Secretary Donald Rumsfeld especially his link with Iraq
war and Al-Qaeda and his famous war against terror style especially
rumour of him sanctioning torture of prisoners at Abu
Ghraib and Guantanamo Bay. Believe me I think say mr
Rumsfeld don work for Abacha before o, because if you see
the way dem beat and molest the prisoners, e similar to the one
dem do for Obasanjo and co.
|
|
The gist is about 'Pillow Talk' and messing im dey received
from im old wife. He admit that when dem wake up every morning,
the first question im wife go ask even before greeting him na
'Donaldi! where's UBL' my brother & sister you go dey
wonder wetin UBL stands for, may be na one of the secret code for
CIA/FBI, but no, na Osama Bin Laden she mean o, 'Olodo!
Woman', 'Coupon', how come Osama come turn to Usama, only Gods
know if she goes school sef. |
Wetin
Mr Rumsfled never says his how he dey feel jealous of Bin Ladin
as he don dey feel insecure that his wife come dey fancy the
most wanted man on earth, even sef on the solar system.
Mrs Rumsfed, please give the poor man a break small, even sef
you dey lucky to have such a man, gisters knows say an average
of the men wey dey read this tory na another headache dem dey
get from their wife in the morning, like
'Baba Ngozi wetin rubber dey do for your wallet'; 'Tunde!
Why you no pick up your GSM'; and so on
|
Copyright © 2000-2004,
Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.
|