Gist & Gossip

Chicken-Heart Saddam

Its no more news say dem don capture Saddam Hussein after months of playing hide and seek with the American troops but the thing wey baffle us most the the way and manner wey dem take capture the man. Imagine person wey get numerous palaces before na for inside one rat hole for a farm house dem find am.

We think say Saddam na Braveheart not knowing he is a Chicken-heart wey just waste people’s time, life and commitment, at least we know how other terrible leaders like him ended up, fight to finish style, Abi he no dey watch film.
Wetin sef he wan do with the money we dem find with am? Abi rats wey dey live with him get market wey he dey patronise or the money na the rent wey he dey collect from the rats since?

At least Tony (B)Lair heart no go malfunction again and Small Bush no go sneak enter Iraq again.
Abeg make dem try and arrest all the Saddam look-alikes so that we no go hear stori again.

And to all the Saddam-likes in Naija, wey think say gofment na dem birthright make dem think twice o, becos what goes around comes around.

Nzobu! Zobu! Enyimba! Enyi!
Chicken-Heart Saddam
DESIGNER VILLAGE FOR QUEEN'S VISIT
NIGERIA IS SAFE ONLY BY TAFA
D1 FOR TOOTHPASTE ADVERT
   
   
 
Archives...

Copyright © 2000-2003, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.