|
A
typical Naija man will capitalize on any situation to make quick
money. Na all of una wey dey live for 'oyibo' land know
say the first safety precaution when you drive na to fasten your
seat belt. Also we know say for our 'obodo' Nigeria safety
is not in our culture, we no care which condition the car dey
as far as the 'thing' can move from 'Orile Mile 2
to Ojuelegba' na 'go on soun' be that no wonder many lives
don lost. The reason why we dey preach all these sermon since
be say The Federal Road Safety Corp (FRSC) don compulsory
the use of seat belt for drivers all of the country
now.
|
|
Any driver wey no use seat belt and Road Safety catch ma na N5,
000 fine be that straight 'no begging bobo'.
As we all know say 90% of the car wey dey Lagos road na 'tokunbo'
dem be and we know how most of dem take enter the country, abi?
Well for those of una wey no know, most of these 'toks' enter
Naija through Cotonou and when dem dey bring them to Naija dem go
don cut the seat belts to serve as towing rope since
dem go don remove all the vital parts of the engine so that dem
no go steal am for port. |
| So
when government don compulsory the use of seat belt wetin go come
happen now? Well, trust 'my guys'
as the saying goes 'drastic situation requires drastic measures'.
You no need to worry about seat belt if you no get inside your car
becos wetin you dey find go 'Sokoto dey for your sokoto pocket'
as 'boyz' don dey sell 'tokunbo'
seat belts for 'go slow' along major highways in Lagos like
Maryland, Yaba, Ojuelegba, Ikeja, Allen Junction even you fit get
for all those 'posh' areas for Lagos too like Victoria Island,
Ikoyi etc |
|
|
If
you buy for 'go slow market'
you go spend about N1500 include a quick fixing by the
roadside but if you go to the popular Ladipo spare parts market
for Mushin Olosa 'tokunbo'
seat belt, for a Toyota car together with the belt engine was
by the weekend selling for about N2500, while that of a
Mercedes Benz was as high as N3000. The belt only, for
different brands of vehicles, now attracts as much as N1000
depending on your bargaining ability and the vehicle type after
you go come pay N500 for fixing. Many
molue drivers wey dem molue no fit pass MOT don dey use seat belt
now but some of them still dey complain say dem dey forget sometimes
|