Gist & Gossip

Chop 'n' Quench

As una dey read this piece our dear Super Eagles dey the land of the rising sun dey put finishing touches to dem preparation for the World Cup.

But before the boys fly comot go Japan, they were hosted to a fund raising dinner organised by Niteflite Promotions in London where the boys enjoy themselves before the long flight to the far east.

Home Sweet Home
Na true our elders talk say, “East or West, Home is the best”. As una know say most if no be all, of our players dey play Pro for Europe, by so means say na burger, pizza dem go dey whack most of the time, apart from Mr Kanu, as Gisters dey see am for Naija joints in London. But these boys show say dem never forget “eba, akpu, amala” and other Nigerian delicacies.
In fact na the captain of the team Jay Jay Okocha lead by example, as menu menu come begin. The chef come first do oyinbo style, dey serve leaves for appetizer, na im make Jay Jay ask for proper naija food and the rest join in. As the hot pounded yam with egusi soup land for him table, Jay Jay show say no be for only the field of play he fit dribble but also inside plate as he demolish the pounded yam like say na England defence he dey deal with. We hope say NFA carry enough cassava follow these boys go Japan o, because e be like say na the food go give dem extra energy.

Chop 'n' Quench
Any fan of Wilson Oruma in the house? Sorry O, if you be one.

We now know why the boy dey play nonsense for field. At the dinner, come see Wilson wey fumble and wobble in the match against Ireland and e no even shame, as he just dey demolish the plate of pounded yam wey dem serve am.

Abeg make somebody advise this boy say person wey get bald head like him no dey do weaving, we dey sure say na attachment he use for the weaving, no be him natural hair. Thank God he no go World Cup sef.

My brother Wilson, make you no mind Gisters, e go better! There is still room for improvement, we just hope you no go leave am late, you know as per age wise.

The Negotiators
Chei! Nigerians, we sabi negotiate no be small o. Come see how Terry Waya and Abdulsamad Rabiu dey negotiate how much dem go donate for the Eagles at the fund raising proper as if say na garri dem wan buy for Benin-Ore expressway. My brother money good o, when two money bags put heads together for the sake of encouraging the Super Eagles.
Everybody wey present just open mouth so tay saliva dey drop for some and when dem announce the outcome of their short meeting at the high table with pounded yam and nice Egusi soup in front of them, ground full for pound sterling and dollars.

Super Cook
We have to give credit to the head of the Cook for Holiday Inn Hotel, Funmi Lewis for the wonderful, delicious and belleful food wey she treat our Eagles and the rest of us to on the night, as you can see how Ribi of Gisters dey take care of himself.

No wonder, why this people (Holiday Inn) come hire her to bring African flavour for their

intercontinental dishes, even we dey hear the rumour say dem wan introduce Pounded yam, Eba, Akpu, Jollof rice to their food menu.

Our sweet sister, more Vaseline to your elbow.

Well done!!
And Finally, Big up for the organisers of the event, ‘Niteflite’ Promotion wey dem oga be our one and only Prince Wale Osiyemi Jnr. You can imagine the event wey go take meetings upon meetings, years upon years and egunje upon egunje, for some people to organise, na only five days e take this energetic young man to put together and he was able to shake the ground as you see the photo for Gisters.

Gisters Crew dey really happy say a young man fit come up with this good idea just to support our dear Eagles, when our suppose hmm.. sit down there, no do anything. Make we wait till Eagles win the World Cup, na then you go see them with flowing butterfly Agbada, dey blow mouth and throway parties for Eagles, just as dem do for our Agbani Darego when she go win Miss World.

Super Eagles' Signed Autographs

 

CHOP 'n' QUENCH
"ROYAL RUMBLE" IN HOUSE OF ASSEMBLY.
GARRI SCARCITY HITS NIGERIA
"NO RESPECT"- KIRIKIRI PRISON ROBBED
"ARSEN-SENAL" GUN DOWN THE DOUBLE
Archives...

Copyright © 2000-2001, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.