| Sometimes
ago when Shan George talk for one interview say the love wey she
get for her husband na only death fit put asunder na everybody take
siddon look posture dey wait wetin go happen becos no be the first
time or the first man wey this "mulatto"
actress go make that kind statement. |
|
But
with the kind "katakata" wey burst between Shan George
and her husband at the recently held EMMA awards in London no be
death wan put asunder for this girl's romance with her husband o
but the one and only self acclaimed Nigerian "Ambassador of
Sports", John Fashanu a.k.a "Mr Fix It".
We know say una go dey wonder say wetin we dey gist about; when
your truly met Shan George at the last EMMA awards she dey in the
company of self acclaimed "Ambassador Fashanu" |
|
True
to God o, Shan no follow him pass the reception area, but we no
go say we know wetin happen or whether dem don exchange numbers
before and after we see them but the poor girl no spend two minutes
before she return but we were surprised when after the show Shan
came out with a stern looking man behind her and introduce the
bobo to us as her husband and subsequently asking us to tell her
hubby where she dey.
|
But
Charles, George, Emeka or wetin be your name why una dey wash
una dirty linen for public if una no trust each other why una
marry? We no know why you dey vex sef abi you think say na you
go be the first person wey Shan go tell say she love? And definitely
you will not be the last abi who no like better thing. On the
other hand we no blame you jare "oko iyawo" we like am as you
bone face for your wife before "Fash the Fixer"
take bribe fix your wife but next time no be public dem dey
show that kind shakara abi insecurity dey worry
you too?
|