Gist & Gossip

Solek Crew - "The intrigues, politricks and bad belle"

There is no business without its own ups and downs, and as elders dey say "na only dead people dem no dey talk about" but we beg to disagree on that, as people still dey talk about MKO Abiola and June 12 despite the fact say dem don die.


Well that one na by the way, wetin we wan gist about na the recent happenings among the Solek Crew as una know say we no dey see make we no talk, that is why una don tag us the "gbeborun of London" (we no vex).

Una know say the Solek Crew is like the famous "Three Musketeers" but now stori don get K-leg;

Michael E: intelligent report reaching us say the bobo don quit Solek Crew to join raving hip-hop group known as JJC band. Haba! Michael wetin happen abi Solek no fit pay for your "expertise" again or the tungba & fuji wey dem dey play too much for you.
We even hear say the Solek Crew wan take you back when you wan kill dem with apologies but na when dey wan "re-sign your contract" na then info reach Mr Solek say you don join JJC band. Well we are happy for you at least your CV go read say you once played the Solek Crew - UK's Hottest Naija Band.
But Remember say dem no dey spray one, one dollar for the hip-hop group for party O!
Michael O: is the typical "Chukwumerije" of the band, he is ready to tell the deaf and dumb about Solek Crew so far that one fit give him audience even if not. We know say you are dedicated and focus but we know where your "focal point" dey, if una think say as Soji dey sing and Mike dey back him up, and he no dey take eye follow the dollars wey people dey spray dem, make una watch Mike well well o, becos as he dey sing and dance na all
the dollars his eyes dey follow even he fit tell una how much dem spray dem without counting, that's how good and "Ijebulise" the guy is, so if una thik say na straight the guy dey look and you wan "pam" even $1 na lie, the guy don spot you. Michael if you think say na lie we dey talk, we get CCTV evidence to back our claim, we even fit take the case go Lord HUTTON Inquiries.
Anyway that one na good asset, becos if Solek sack you today, Safeway and Tesco go dey fight to sign you, becos dem know say dem no go need scanner and calculator again as you have everything in-built.
Soji (Mr Solek): wetin we wan talk about you sef? We hear say some people don dey get bad belle for you becos God don dey do wonders for your life. Dem say after you marry our beautiful Comfor, you just knack am with one fine "state of the art, customized E Class Mercedes Benz", na im people come dey vex. Dem no know say we no dey vex with head make we use cap cover bottom when this boy go dey carry speakers in the rain, sunshine and snow, nobody see am o,

or when he no sleep from Thursday to Monday una no see am then o, na only Comfor fit tell us how e be, abi when he go sing so tay he go lost his voice where una dey? abi na him say make una no get talent to sing, at least he no bury his talent like most of una.
Abeg SOJ carry go joo, even if you wan buy private jet na your money wey you work for becos na the same people go dey gossip behind you if dem see you for PRIMARK dey do shopping dem go say you be "Ijebu". Well Ebenezer Obey don sing say we no fit satisfy people.

Abeg Solek Crew can you supply us the foto of the new face of Solek jare...

The boring saga of Item 8 - Fashion Show!
Solek Crew - "The intrigues, politics and bad belle"
Shan George in "yawa" at EMMA Awards
Aso Rock Villa, No. 1 illegal structure in Abuja
World superpowers to seek NEPA support
 
Archives...

Copyright © 2000-2003, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.