Gist & Gossip

"INTELLECTUAL INTELLECTS" = GARI FOR COMMON MAN?

The city of London recently hosted "intellectuals" from Nigeria and God, na there we know say these English wey we dey speak na "ordinary" English. All of una wey dey London dey speak with una nose like say hot potato dey your mouth and dey copy these "oyibo" people, una don miss road patapata because the origin of grammar na for Naija e dey.

The gathering was for the "father of English" himself, Prof. Wole Soyinka, for his Annual Lecture Series, come see how all these "intellectuals" dey fight wetin G-Crew term "grammatical warfare".

At one stage yours truly no even understand wetin dem dey talk again, we think say dem don change to another language not knowing say dem still dey yearn this "our" English.
No be only grammar these "intellectuals" fit blow o, infact dem dey translate Yoruba proverb to English. If una think say we dey lie, this one na poser for una and anyone wey get am go get free English lecture from Prof. Soyinka- "Pòtòpótò táa nà lábàtà, enití ó bá ta sí lára, kó jòwó kó foríjì wá o".
Katakata burst when yours truly encounter Prof. Soyinka after the lecture. Out of all the things wey the Prof said to me that day, upon all the money wey my parents take send me to school, I swear I no understand anything becos the kind grammar wey the man dey blow pass my own. I just dey nod my head like agama lizard and dey smile, as he turn to greet someone na so I just disappear among the crowd. Trust G-Man now, nobody fit catch us for corner.
Well we think say all these intellectuals sabi say no be dem big big grammar go bring gari, yam and akpu for common man for Naija o, because that na the only "intellect and grammar" wey common man sabi o.


Gisters chill out with KSA
"Intellectual intellects" = Gari for common man?
"Commonwetin"?
"Nigeria Airwaste"
At Last World Cup for Us!
Half_Baked Police Graduates
Local Hunters
LAGOS NA WA!!! - GISTERS' EXPERIENCE
Black Pickin White Parents
Kanu+Cash=Van Bommel
Archives...

Copyright © 2000-2001, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.