Gist & Gossip

XMAS AWOOF LAND OC FOR YAWA

Una go say wetin our dear Nigerian Police Force… opps! (They don say dem no dey use 'Force' again na 'Command' so dem be Nigerian Police Command or simply Nigerian Police) do us abi?

We for Gisters believe say to invite foreign investors into our country we have to stabilize it first and stability can be achieved when the citizens are safe from any danger that means we have to have a good security network, abi? If we like make una tell us o.
Na everyday we dey read am for paper say dem oga armed robbers do this dem do that so tay person go dey wonder whether we get police at all. How our policemen go prevent robbery when e be say na highways such as Lagos-Ibadan, Benin-Ore, Lagos-Seme and so on dem go dey go mount toll gates as if say the ones we government put there no do.Na Tokunbo this Tokunbo that dem go dey run after when innocent citizen dey lose their valuables for our towns and cities.
This na festive period the kind we my small cousin dey call 'rice and chicken season', una know say na this period of the year chicken and turkey population dey reduce drastically and 'Mama Uzors' wey get beer parlour go declare profits because na jollyficate season we dey.
The other item we dey suffer for this season na the 'almighty rice' because every household must cook rice even if na to take 'ponmo' or 'oku eko' wack am if you cannot afford chicken or turkey.
This is a must as even the household wey be say na 'akpu' and 'lafun' dem dey wack all year must cook rice on Xmas day. Upon all the above facts, how our police go dey arrest trailer wey dey carry bags of rice go market for ordinary citizens like you and me to buy so as so enjoy Xmas?
As if that one no do, when dem eventually release the trailer load of rice, 100 bags don waka from the 'safe custody' of the police upon investigation, the officer wey dey in-charge of the case (OC) was suspected but oga deny knowing anything about how the bags of rice grow wings and fly away.
However, as God dey catch liars, the driver wey the OC sent to carry some of the bags of rice to his wife just arrive with the 'good news' for oga say he don deliver the goods to madam, na there tory come get K-leg as Oga no fit deny again.
At the end of the day we hear say OC don sell 92 bags to market women and sent 8 bags to his wife so that him and his family go get plenty rice chop for Xmas.
Chei! Na wa o, see the person wey government dey pay make he protect innocent citizens na him dey steal from dem. Well, God dey sha.


NIGERIAN POLICE AND ARMED ROBBERS - 'WETIN DEY HAPPEN'
ROYAL RUMBLE IN SUPER FALCON'S CAMP
XMAS AWOOF LAND OC FOR YAWA
PASSENGERS DEMANDED $1.3M FROM 'NAIJA AIRWASTES'
FIRST BANK NIGERIA PLC- ...TRULY THE FIRST???
ABIA STATE GOVERNOR FINISH FIRST DEGREE
NIGERIA AIRWAYS OR "AIRWASTE"?
AWOOF DEY RUN BELLE
THE NEW IMPROVED KANU "JOGO BONITO"
CUNNY MAN DIE CUNNY MAN BURRY AM
Gisters chill out with KSA
"Intellectual intellects" = Gari for common man?
"Commonwetin"?
"Nigeria Airwaste"
 
Archives...

Copyright © 2000-2001, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.