gsports

 

Ghana Nigeria Friendly

It's no more news that the "Not so Super Eagles" Nigeria were seriously trounced by the impressive Black Stars of Ghana in a friendly match at Brentford's Griffin Park stadium. Due to this heavy loss, our "Tired Eagles" has been relegated to 36th place in FIFA ranking
Trust GSports to dish you all the dirt before, during and after the game. It's a classic tale of "to fail to prepare is to prepare to fail" for one team and "there is reward for hard work" for the other.
From Naija national coach not having a clue about his players' whereabouts to fans encroaching the pitch during half time and after every goal scored, it's surely a case of naivety everywhere you look.

Clueless Eguavoen

For this day and age wey communication don spoil everywhere, e be like say na only our national manager Eguavoen still dey live for stone age era as he no dey in tune with tekinologika advancement to keep in touch with his players all over the world. Imagine Naija national coach asking a journalist from Naija the latest news about Obafemi Martins and Mikel Obi when he should have direct contact with the players and their club to know where dem dey.

So we no dey surprise when during the match Oga Cerezo no even know which tactics to play he just stand there dey wave his hands like 'Yellow Fever' for Ojuelegba making signals like Morse code or abracadabra (the more you look the less you see) wey only him fit understand, no wonder the players dey confused.

Invasion Brentford Pitch

When are we going to learn how to behave? If you come see the way both Charlie and Naija fans dey invade pitch at half time and whenever Black Stars sneak another goal into Eagles' net una go think say na Kokovelli or Lagbaja concert we dey. We go advise any future organizers of any matches involving African teams to import security guys from Africa wey know how to do pest control sorry control crowds. But the good thing about the whole na the fashion parade wey some girls give us especially dem warm us up with dem skimpy skirts wey dey struggle to cover dem big ikebe. We pity the Brentford Stadium Ground manager the following morning as we sure say dem go relay that pitch very soon as e suffer from some long pointed stilettos no be small

Yakubu's smiling entrance

Dem say first impression dey last well well no wonder when Yakubu enter as substitute na Close Up toothpaste smile he first flash to Essien. Yak de Yak, we know say na friendly match dem call am, but my broda, Ghana dey pepper us 4-1 when you enter and our national pride dey for stake. You for even keep your emotion small as we know say Essien dey earn pass you and he dey play for bigger and better club. But haba! If shame no catch you, shame catch the rest of us o. if to say na autograph you want, you for respect the paying fans small and wait for the match to end and collect am for dressing room. Abeg be careful o!

Mikel! Mikel!! Mikel!!!

Na how many times we call you?

Since the last WYC in Holland Naija team lost in the final to Messiful Argentines, football fans in Naija has remained hopeful about the future of Naija football especially the 'talent' of one Mikel Obi. When Chelsea and Manchester United begin fight becos of the boy again we think say our saviour don come but the player wey we see play for Naija against Ghana no even worth fighting for between 'Sootin Stars' and Raccah Rovers in Naija league.

The boy just dash the hope wey all him kontry people placed on him and to think say na this same boy Mr Loudmouth Mourinho of Chelsea dey threaten Naija with FIFA becos we play our own player for FIFA approved match. And Mikel too no help matter when he claim say Naija people in Naija dey threaten him family if he no play. Abeg we dey implore the people wey dey close to Mikel to advice him well well o, make he no let him head swell pass him skills o, that is if he get any. Instead of improving himself we hear say you be popular jingo for every Naija joints in London and nightclubs in the West End. A word is enough for the wise. Make you just take a look at Etim Esin's career. Full stop!

 

Obafemi say Sorry

Igbira people go say 'de de me da ho' meaning take am easy. Obagoal, Obarun, Obasomersault, no turn yaself to Obalie. We no say you dey lie o

We understand say nothing pass mother especially from the society wey we come from, becos if person dey earn the kind money wey you dey collect and you no take care of your Mama na yours truly go first fire you serious epe (curse).

You know say football is a matter of life and death for Naija people as that is the only thing wey dey bring the Ibos, Yorubas and Hausas together. If you know say Mama no dey feel too well for Abule, you for still report to camp and excuse yourself at least that go show say you get respect.

Wetin we fit do as you don say sorry than to forgive you. There is a saying that 'if we use right hand punish pikin, we go use left one comfort am." Just no let that boy Cele corrupt you o.
Greet Mama for us o, hope she don dey feel better. We wish her sooner recovery

Kanu warms up- in trainers

While the Ghananians dey teach Naija lesson on the pitch, Papillo just dey take am easy for sideline. Even when dem ask Igwe to warm up he just run for few minutes in his trainers and return to sit down all wrapped up. Who go blame him, the cold that day no be small.

Ghana in Colonial Chant

, Haba, after 50 years of independence we think say our e ti sen brodas and sistas go don forget the colonial mentality, but na lie O. Trust the NFA supporter under the everlasting rule of our life time President General the trumpet and drum just dey jam numerous sweet melody until the goals started raining in but wetin happen to the Kofi people na Colonial Master ole! ole!! ole!!! ole!!!! chant rented the air when dem score. Wetin happen to Ghana songs by likes of Mzbel, Praye, Wuta etc?

Party atmosphere after the match

Where Naija dey there must be party and where Ghana dey there must be plenty of bakassi. The result of the game no spoil the brotherly love between the two set of fans as they partied in good spirit after the game. While the Ghana fans busted to a popular Naija song "Nigeria jagajaga, everything scatter, scatter". Naija fan responded with the chant "Ghana must go! Ghana must go! Ghana must go"!

Match ended in a draw

Naija 0 - Ghana 0
Thousands of Ghana fans go home with the believe say dem beat Naija 4-1, but the Gsports get evidence say the match ended in 0-0 as the score board show at the end of the game so Naija is still unbeaten bay Ghana in 15 years.
We no know if na cold catch the score board or na our Mr Fix It for Naija go give the operator egunje.

Suffering Press

The thing wey yours truly eyes see before he enters the stadium no be small. We think say na Europe we dey, but our experience for the press entrance can be likened to trying to negotiate the Tora Bora mountains in Afghanistan to see Osama. The scene resembles when you wan enter Onikan Stadium to watch Flaming Flamingos or Olubadan Stadium to see Sooting Stars play.
The lack of organisation no be small, imagine the media representative for the organiser wey suppose to provide information for the press, asking the people he is suppose to be giving info to for info. Na wa o.

 

Congratulation

Gsports will like to use this opportunity to congratulate Africa and thanks FIFA for put up a cup championship for the amputtes in Africa. The maiden event was held in Sieria Leone where lot of able men had their legs amputated during the war. Atleast the shows there is still hope for us in Africa.

it seems na Ghana dey in form now o because na dem carry the cup at the tournament.

 

As you know us, we always give you top events, we are presenting you with exclusive pictures from the friendly match, from the Super Eagles' camp to the Black Stars' camp, please do enjoy yourself. We also take this opportunity to congratulate Ghana and Chalie Boys, make you enjoy it while it last, and as for the Naija, dont worry na only friendly we play and we shall retaliate.

click on pics to enlarge

Super Eagles Camp

Black Stars Camp
Ghana V Nigeria
Happy Fans

 

Ghana Nigeria Friendly
African Premiership Players